Padi dem, contry, una ohl wey day Na Rome
Meyk una ohl kak una yeys
A cam ber Siza, A no cam preyz am.
Dem kin memba bad we pohsin ken du
Lohng tem afta di pohsin kin don die.
Boht plenti tem di gud wey pohsin du
Kin ber wit im bon dem. Meyk i bi so
Wit Siza.